Come hear your Tori wey u no gree wan talk...

How e dey be my people…
Plenty things wey I go dey yarn for here go be things wey you sabi, things wey dey touch you but you no dey like yarn am.
Since we dey always dey keep this things to we chest, I say make I open place make we dey pour am out as you dey take empty your old Jean pocket just to find money wey you no forget.
My name na tbb and for the benefit of those wey no sabi, tbb mean tall brown boi, when u sha see me u go code. In my everyday life, I be phoneographer, read am again I no say pornographer even though I for like do one porn sha but that na Tori for another day.
So my phoneography be say I dey take pictures wey go make you see magic with only my phone. When you see my pictures, e go be like that short sweet moments before you cum. E dey sweet for body.
Well, on other days I dey talk plenty sweet Belle stuff and my substack in line with my fellow badass bros dem na my space to rant, share, wild n vibe and if u no go mind all that razzmatazz, then me and you go be padi for a long time!!!
Welcome!


We deey here
Abeg yarn I dey feel you bro